Africa inside foto: 30 December 2017-4 January 2018

Published

Dis na list of some correct foto wey show for different areas inside Africa dis week.

Someone in a Mohican watching New Year's Eve celebrations in Victoria Falls, Zimbabwe - Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, People shock as dem dey look New Year jollification for Victoria Falls for Zimbabwe…
Fire spinners performing at Victoria Falls Farm School - Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di concert wey happen for Victoria Falls Farm School reach three days for di town…
Crowds cheering in the New Year in Nairobi, Kenya - Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, People hala for Kenya capital , Nairobi, for one event for Kenyatta International Convention Centre...
Fireworks at Mary Fitzgerald Square, Johannesburg, South Africa- Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Na so people carry dia phone dey film New Year fireworks for Johannesburg's Mary Fitzgerald Square for South Africa...
Men playing bag-pipes at sunset, Cape Town, South Africa - Sunday 31 December 2017

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Di day before, wey be Sunday, some men play music as dem dey look di sun for Scarborough beach wey dey Cape Town for South Africa...
Crowds swimming on a beach in Durban, South Africa - Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di next day na so South Africans enter Durban beach for South Africa to baff away 2017 and welcome di New Year...
Shembe followers take part in a cleansing ceremony in a Durban township, South Africa - Sunday 31 December 2017

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dem dey call am Shembe for South Africa Nazareth Baptist Church, wey mean say dem dey do 'cleansing'. People wey dey follow di religion do ceremony before pilgrimage wey go Nhlongakazi mountain wey dey north of Durban...
Performers at the Minstrel Festival in Cape Town, South Africa - Tuesday 2 January 2018

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, For Tuesday, people dress for di Cape Town Minstrels Carnival, wey start for slavery era for Cape Colony when masters bin dey give slave holiday di day after New Year.
Children playing on the seesaw at the Millennium park in Abuja, Nigeria - Monday 1 January 2018

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For New Year, children dey play for park for Nigeria capital, Abuja for Monday.
Stewardesses of Addis Ababa-Djibouti Railway at Nagad station, Djibouti - Wednesday 3 January 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, For Wednesday wey pass, stewardesses for Addis Ababa-Djibouti Railway dey pose when dem arrive for di first commercial train from di Ethiopian capital at platform at Djibouti's Nagad station.
Eritrean refugees smoke water pipes outside the Holot detention facility in Israel - Wednesday 3 January 2018

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Di same day, Eritrea refugees dey smoke shisha outside di Holot detention centre near Nitzana for di Negev Desert wey no far from Israel border with Egypt.
Soldiers with drums standing before President Omar al-Bashir, Khartoum, Sudan - Sunday 31 December 2017

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, On Sunday, Sudan President Omar al-Bashir do speech give im country for di 62nd anniversary of the country independence for di palace for capital Khartoum.
People looking at the "Daily Talk" chalkboard paper in Monrovia, Liberia - Sunday 31 December 2017

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, E good to see say Daily Talk chalkboard for Liberia still dey happen - even for New Year Eve for Monrovia, people still dey read di final result of di presidential election wey George Weah win.
Cows on a beach in Zanzibar, Tanzania - Sunday 31 December 2017

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Cows come balance dey cool dia temper for Tanzanian island of Zanzibar

All foto bin come from AFP, EPA, PA, Reuters and Getty Images.