Ghana wan ban native names like 'Nana' and 'Naa'?

Ghana flag

Wia dis foto come from, iStock

Wetin we call dis foto, Some people provoke say di registry dey against local Ghanaian names.
Published
Read am in 1 mins

Social media dey para for Ghana say di Births and Deaths Registry say dem no go dey allow people to dey register some kain names wey be titles for dia birth certificate.

John Agbeko wey be Registrar for di Births and Deaths agency explain say native names like Nana, Nii and Togbe no really be names but na titles for traditional leaders. Agbeko say dem wan try use am control di way citizens for Ghana dey give names.

Some Ghanaians provoke for social media as dem begin complain say di registry dey approve English names but dem dey against local Ghanaian names.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Plenty people don complain say anytime dem try add names like Nana, Torgbui, Nii, Maame to dia pickin names, di registry no go gree.

Di registry deny say dem dey against local names but if person wan choose local and English name, di English name go come first before di local name because Ghana na English-speaking country.

Di ban don affect some adults wey wan do birth certificate but don already dey answer names like Nana and Nii because dem go need swear affidavit.