Liberia: Weah don begin to make sharp sharp change for government

Liberia

Wia dis foto come from, JOEL SAGET/AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, George Weah replace Ellen Johnson Sirleaf as president
Published

Na just days inside im presidency, already former footballer George Weah don begin dey make sharp sharp changes to di way Liberia dey run dia government.

Weah don order all "autonomous agencies and public corporations for government" to reduce dia operational expenses from $3,000 (£2,100).

Any wish wey exceed di budget, "must get approval from di office of di President", na statement wey dey di Executive Mansion website.

E go allow di important people for di agency and corporation dem to sign off all "legitimate salaries and other benefits".

Na just Monday Weah enter office and im promise to fight corruption.