Grammy: South Africa group Ladysmith Black Mambazo don win

Ladysmith Black Mambazo

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL/AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Ladysmith Black Mambazo be one of di top successful man choir form Africa
Published
Read am in 1 mins

South African band Ladysmith Black Mambazo don carry di Best World Music award for di 2018 Grammy Awards ceremony wey happen overnight for New York, US.

Dis na di number five award for di all-male group wey don popularise dia Zulu style of harmony-singing, wey dem dey call isicathamiya.

Di album wey dem use take win di award na Shaka Zulu Revisited: 30th Anniversary Collection.

Na tribute to di members wey start di group, wey be say young-young members don begin take over.

Di thing sweet di South African government sotay dem congratulate dem for Twitter:

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di Group also get 19 Grammy nominations, one Academy Awards nomination plus Emmy Awards nomination.