CHAN 2018: Sudan carry 3rd position

Wia dis foto come from, BBC Sport
Sudan don carry third for di African Nations Championship (CHAN).
After dem play full 90 minutes with Libya wey di game end 1 - 1, na im dem move straight to penalty.
Everybody dey hail Sudan goalkeeper Akram El Hadi after im do better-better save for di match and even penarity to secure im team third position.
Sudan bin don dey lead di match after eight minutes wen attacker, Walaa Eldin Musa score for im team.
But with just six minutes make game finish, na im Salem Ablo equalise for Libya.
Sudan no miss any of dia penarity, sharp-sharp dem land dia four shots but Elmehdi Elhouni and Ablo of Libya no get dat kain luck after Akram block dem shots.
Dis go be di second bronze medal for Sudan for CHAN.
For 2011 dem also carry third
End of Di one wey oda users dey read well well











