Africa week for picture: 16-22 March 2018

Published

Dis na some of di best photo from different parts of Africa, and also about Africa people wey dey different parts of di world dis week.

Dis photo dem na from AFP, Reuters, EPA and Getty Images

Small Congo boy stand on top tree for IDP camp inside Kalemie, Democratic Republic of the Congo. Big palm trees and small camp dey im back.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Congo pickin dem for inside IDP camp for Kalemie, Democratic Republic of Congo. Fight-fight among different tribes don force 67,000 people to run comot from dia house.
Model dey do catwalk during African Fashion International Fashion Week for Cape Town, South Africa as pipo gather dey take photo. Di model wear cloth wey UNICEF ambassador and South African designer Gavin Rajah sow.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Models present work wey Unicef ambassador South African designer Gavin Rajah do for African Fashion International Fashion Week for Cape Town, South Africa.
Man dey adjust mast for boat inside south east Kenya.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Man dey adjust mast for boat wey carry tourists cross wata for coast of Lamu Island, popular beach for Kenya.
A sheep wear medal wey im win for three-day auction wey dem do for Misrata, Libya.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, A sheep wear medal wey im win for three-day auction wey dem do for Misrata, Libya.
Many of di Dapchi girls wey dem bin kidnap, dey line dey wait dia turn to enter plane for air force base Maiduguri, Nigeria.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Some of di Dapchi girls wey dem new release dey enter plane for Air Force base Maiduguri, Nigeria. Government say dem release 105 girls plus one boy, but five girls die.
Plenti men pack demsef enter lorry with dia belonging after dem release dem from Bujumbura, Burundi.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Former prisoners dey enter truckafter dem release dem from Mpimba Central Prison as part of a mass presidential pardon, for Bujumbura, Burundi.
44 African heads of stand for background wey say "African continental free trade area, creating one African market. #AfCFTA2018 17-21 March 2018, Kigali, Rwanda."

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, African leaders pose for African Union (AU) Summit wey dem do to establish African Continental Free Trade Area for Kigali, Rwanda on Wednesday to create one of di world biggest free trade bloc. Ten kontries plus Africa biggest economy, Nigeria, no follow sign as dem dey fear say e fit reduce work for dia kontries.
Football supporters for Mhiri stadium, Tunisia dey wave flares and flags during friendly match against France. Dem dey celebrate dia club 90 years anniversary

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Tunisia Sfax football supporters wey wave flare for friendly match against former French international players to celebrate 90 years anniversary of di club for Mhiri Stadium for Sfax.
Photo of first Zimbabwe Miss Albino Sithembiso Mutukura as she wear crown hold flower for competition wey happen for March 17, 2018, in Harare.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Zimbabwe first Miss Albino Sithembiso Mutukura collect flowers after dem give her crown for Harare. Di 22-year-old beat 12 other contestants for di first Zimbabwe Miss Albino competion to helep reduce stigma of di condition.
Young Congo fisherman dey fix im net for bank of Lake Tanganyika for Kalemie, Democratic Republic of the Congo. he roll im trouser up and im wear polo with jacket.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Young Congo fisherman dey fix im net for bank of Lake Tanganyika for Kalemie, Democratic Republic of the Congo.
Two boats carry men for lake inside Madagascar as plenti bus and people dey look di katakata wey di heavy rain cause Eliakim near Manambonitra, Atsinanana region, Madagascar.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, After very heavy rain for Eliakim near Manambonitra inside Madagascar, on Sunday.
Woman dey pour water for bucket for Abidjan, Ivory Coast, as small boy dey watch.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Woman dey pour water for bucket for Abidjan, Ivory Coast, on Wednesday, di day before World Water Day. Di theme for World Water Day 2018 na "Nature for Water."
One man and fada for South Sudan dey inside hut for refugee camp for Obo. Di man dey back camera as im face fada as in dey say mass.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, South Sudan Fada dey say mass for Central African Republic refugee camp for Obo on Friday. Since 2016, more than 2,000 pipo don cross border to escape civil war for South Sudan.