
Dem born Ms Madikizela-Mandela for Bizana inside Transkei wey dey Eastern Cape.

Wia dis foto come from, AFP/GETTY IMAGES
South Africa don start di four-day ceremony to bury anti-apartheid activist Winnie Madikizela-Mandela wey die for 2 April afta long sickness at di age of 81.
Na thousands of pipo gada for Orlando Stadium for Soweto, di venue for di public memorial service, to give Madikizela-Mandela final respect.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis memorial dey happen four days before di funeral service for Saturday.
Before she die, Madikizela-Mandela dey live near dis stadium.
Na with military style ceremony gofment talk say dem go use bury di wife of South Africa first black president Nelson Mandela.
Gwede Mantashe, wey be di chairman for di ruling African National Congress party, talk say dis memorial na jolli-jolli bye-bye because Madikizela-Mandela na di 'mama of di country'.
During dis long memorial service, thousands of pipo sing and dance for di Orlando Stadium for Soweto to remember dis special woman.

Wia dis foto come from, Getty Images
Among di VIPs wey show na Graca Machel, wey be di former wife of Nelson Mandela, odas na; South African deputy president, David Mabuza, Energy Minister Jeff Radebe, Rita Ndzanga and Zulu chief Mangosuthu Buthelezi.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mabuza talk during di service say di last thing Winnie Madikizela-Mandela try do before she die na to raise money for di family of one five-year-old girl, Viwe Jaliwey, wey die afta she fall enter pit latrine for her primary scool.
Mabuza talk say, ''Mama Winnnie na "gallant fighter" till di end of days.
Afta di minority white government lock Nelson Mandela and other ANC ogas for prison, Winnie continue to fight for freedom for her husband and di black majority for South Africa.

Wia dis foto come from, AFP
Na social work she bin dey do wen she first meet Mandela for 1957 and dem marry few months.
Even though di marriage reach 38 years, dem no live as man and wife togeda for long time because Mandela dey prison for 27 years.
But she lose respect wen one group she form, di Mandela United Football Club, wey turn vigilante group kill one 14-year-old, Stompie Seipei.
South Africa independence for 1994 reward Nelson with di office of president and Madikizela-Mandela with deputy minister and lawmaker with di ruling African National Congress.
Na for streets her real power dey but she still popular for ANC sotay she dey always score di highest number of votes for di national executive council wey dey control di party.