Nigeria senators dey discuss weda to impeach Buhari

Published
Senators for Nigeria National Assembly don raise motion to impeach President Muhammadu Buhari.
Di senators say di president no collect approval from lawmakers before e buy aircraft from United States.
Na senator Matthew Uroghide bring di mata.
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.







