Alex Badeh: Na who kill former Nigeria Chief of Defence Staff?

Wia dis foto come from, NIGERIAN ARMY
Published
Read am in 1 mins
Former Nigeria Chief of Defence Staff, Alex Badeh don die.
Nigerian Air Force wey confam am for dia twitter account, say na along di Abuja-Keffi road dem shoot oga Badeh.
Skip X post
Allow X content?
Warning: Third party content may contain advertsDis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oga Badeh na retired air chief marshal, wey bin serve under former president Goodluck Jonathan time.
Before im die, Badeh bin dey face accuse of N3.9 billion magomago wen im bin dey office.
Badeh, wey dey 61 years, join di Nigerian Air Force for 1979.








