Coming To America: Eddie Murphy go act as Prince Akeem for part 2

Eddie Murphy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Murphy become global star afta im do di coming to america feem for 1988
Published
Read am in 1 mins

Prince Akeem of Zamunda dey show again for theatres soon and di royal asoebi don ready!

Na Ruth E. Carter wey win Oscar award for her costume design work for Black Panther post for her Instagram page tok say e dey official.

E don reach 31 years since dem release di first installation of di feem and tori be say e fit hit cinema for 2020.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Plenti celebs follow comment dia joy on top di news wey include Fast and Furious actor, Tyrese Gibson.

E no be di only reboot wey don dey pipeline as Will Smith don de do videos of Behind di scenes for di shooting of Bad Boys.