Zamfara govnor don appoint Senator Nasiha as new deputy

Hassan Nasiha

Wia dis foto come from, Hassan Nasiha forum/ Facebook

Published

Zamfara govnor Bello Matawalle don appoint Senator Hassan Nasiha as di new deputy govnor of di state hours after Assembly impeach di former one.

Di govnor forward im name to Zamfara Assembly since di impeachment of former deputy govnor Mahdi Aliyu Gusau don make di seat vacant.

Before im appointment Hassan na di current senator wey dey represent Zamfara central for National Assembly for Abuja.

Di senator show face for Zamfara Assembly as almost all di members agree to make am di 5th deputy govnor of di state wey former Nigeria head of state General Sani Abacha create for 1996.

Already politicians for di state don begin congratulate di new deputy govnor with posts for social media.

Zamfara deputy governor chop impeachment

Wia dis foto come from, Other

State Assembly impeach Deputy-govnor Mahdi Aliyu Gusau

Zamfara state House of Assembly don impeach deputy govnor Mahdi Aliyu Gusau after dem receive probe panel report wey chief judge of di state form to investigate am.

Hon. Ibrahim Tudu Tukur wey dey represent Bakura constituency dey among members wey attend plenary on Wednesday and e tell BBC say na 20 out of di 21 members vote to impeach di deputy govnor.

Na last week Chief Judge Kulu Aliyu form panel to investigate di charges wey Assembly say make dem wan impeach di deputy govnor.

Some of di charges include abuse of office and financial misappropriation.

Salihu Usman Zurmi

Wia dis foto come from, BBC Pidgin

Wetin we call dis foto, Zamfara only lawmaker wey no sign impeachment of deputy governor

Di only lawmaker wey vote against impeachment

Hon. Salihu Usman Zurmi na di only Peoples Democratic Party, PDP lawmaker for di Zamfara state Assembly, na im be di only pesin wey no vote for di impeachment against di Deputy Govnor Mahdi Aliyu Gusau.

Di lawmaker for BBC interview weeks ago bin dey allege say im decision not to partake for di decision to impeach di deputy govnor make am target for di state and say im life dey under threat because of im decision and na why e run away from di state.

“I dey face serious threat to my life just because I no gree join oda members to impeach di deputy govnor and na why di state goment dey see me as K leg for dia plan. “

“Dem feel say to catch or arrest me go allow dia plan to move without any problem, I strongly suspect say di goment dey behind di threats wey I dey face.” E tok.

Hom. Salihu say im decision not to support di impeachment against Zamfara state deputy govnor na because of loyalty to im party.

“I dey very loyal to my party and I also let di oda lawmakers know say wetin dem wan do dey wrong and make dem know say whatever you do pesin go return to you for future.

Na because of my stance on dis mata I become target. Di goment dey see how I dey always dey against di plan on di floor of di house and dem fee say I dey stand in dia way.” E tok.‘

Zamfara deputy governor chop impeachment

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Zamfara state House of Assembly

Na noting but im own imagination'

Media and public enlightenment for Zamfara state Govnor Zailani Bappah tell BBC say wetin di lawmaker dey allege na notin but im own imagination as goment no get anytin against am or anybody for dat mata.

“His excellency di govnor no dey put im hand for Assembly matas therefore no way e go interfere for dis mata talk more of threating any lawmaker life.”

How di mata take start

Na July of last year Zamfara state Govnor Bello Matawalle move to Nigeria ruling All Progressive Congress, APC from di opposition PDP but di deputy govnor no gree move with im boss and political analysts say na from dia im problems begin.

Barrister Mahdi Aliyu Gusau for interview with BBC months afta di govnor decamp say e no go follow di govnor to APC as im mandate na to serve Zamfara pipo and e no dey fear impeachment.

Shehu Bala na political commentator wey dey based in Zamfara state and e tell BBC Pidgin say wetin dey happun to di govnor na sometin wey many expect to happun even before now.

“For Nigeria, no how wey govnor go decamp to anoda party and im deputy no go gree follow am and expect dem to remain togeda, dis na wetin dey happun for Zamfara.

”In fact, if not for di influence of di deputy govnor father, dem for don comot am tay-tay but because General Aliyu Gusau na pesin wey Zamfara politicians dey respect na why Barrister Mahdi last dis long.”

Di analyst say wetin dey happun na just politics and not really about offences as di Assembly dey claim.“Di 2023 elections dey close and alignments and re-alignments dey happun, di govnor dey try balance tins out before voting time so wetin dey happun for Zamfara na just politics.” E tok.